PDP primary election Ondo State: Eyitayo Jegede, wetin we sabi about di main opposition candidate wey go challenge Gov. Akeredolu for Governorship elections 2020

Eyitayo Jegede SAN

Wia dis foto come from, Twitter/Eyitayo Jegede

    • Author, Olaronke Alo
    • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin, Lagos

Di 2020 Ondo governorship election go be anoda battle between Eyitayo Jegede(SAN) of di PDP and di APC sitting Governor Rotimi Akeredolu

Jegede gbab di PDP ticket for di primary election wey dem do on Wednesday.

Eyitayo bin contest for governorship seat for 2016 but im lose to Akeredolu.

Eyitayo Jegede SAN

Wia dis foto come from, Twitter/Eyitayo Jegede

Who be Eyitayo Jegede

Eyitayo Jegede na Senior Advocate of Nigeria.

Dem born am to di family of late Chief Johnson Bosede wey come from di Odopetu area of Akure, di capital of Ondo State.

As im be ogbonge Lawyer, for 1992, Chief Justice of Nigeria appoint am as Notary Public and for di space of less than 10 years dem promote am to di rank of Senior Advocate of Nigeria.

Im bin dey deeply and actively involved for political cases and election petition matters na im speciality.

Afta twelve years wey im practise for law firm, six years wey im dey as Head of Chambers, he start im own law firm, Tayo Jegede & Co for 1996.

For May 2009, di Ondo State, Olusegun Mimiko appoint am as number one law officer of di state, as di Hon. Attorney-General and Commissioner for Justice.

Eyitayo emerge winner of PDP primary election to defeat di Deputy Governorship Candidate of di PDP, Hon. Saka Lawal for di 2012 governorship election.

Im be one of di main opposition of Gov Rotimi Akeredolu for 2016 govnorship wit 150,380 votes against di 244,842 votes of Akeredolu.

Eyitayo dey married to Madam Eno Jegede wey also be lawyer like am.

Eyitayo Jegede campaign

Wia dis foto come from, Twitter/ Eyitayo Jegede

Wetin dey for Eyitayo Manifesto?

For wetin im call 'My Offer' im plans na to

Grow new state economy wey go dey majorly based on public-private partnership.

Take advantage of plenti tourism centres for di state to also grow di economy.

Also dedicate funds to support small and medium scale enterprises for di state.

Provide free basic health care services to pregnant women and children wey dey under di age of 10.

Eyitayo Jegede no be newcomer to contest govnorship election for Ondo State but di question na wetin go change dis year.