Geoffrey Onyeama: Nigeria Foreign Affairs minister don test positive for coronavirus

Wia dis foto come from, Twitter/ Geoffrey Onyeama
Nigeria Foreign Affairs Minister Geoffrey Onyeama don test positive for coronavirus.
Onyeama announce am ontop im twitter handle on Sunday.
According to am, im do im fourth Covid-19 test yesterday afta im notice small irritation for im throat and unfortunately, e come back positive.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di tweet also say im dey waka go isolate for health facility and go dey pray for di best.
Dis one dey come afta di minister lose im very good friend wey also be di former Chief of Staff to President Muhammadu Buhari, Abba Kyari on di 17th of April.
Onyeama go be di latest top public office holder wey go get di virus.
Govnors Okezie Ikpeazu, Ifeanyi Okowa, Rotima Akeredolu, Nasir El Rufai, Bala Muhammed and Seyi Makinde also test positive for coronavirus.
While di former Govnor of Oyo state Abiola Ajimobi die from complications of Covid-19 on June 25, 2020.
End of Di one wey oda users dey read well well
See some of di pipo Onyeama don meet with in di last two weeks
In di last two weeks before Onyeama announcement today say im don catch di virus, di minister don involve for some virtual and physical meetings.
See di breakdown according to posts im make ontop im twitter account.
- On 15 July, Onyeama receive Senator Aliyu Magatakarda Wamakko and Hon. Minister of Police Affairs, Muhammad Maigari Dingyadi.
inside picture im post, all of dem bin wear face mask.

Wia dis foto come from, Twitter/Geoffrey Onyeama
- Di same 15, July, Onyeama also receive Bola Sarumi Aliyu di Senior Special Assistant to Oyo state Governor Seyi Makinde.
- On 14, July, Onyeama receive farewell visit from H.E. Major-Gen Waqar Ahmed Kingravi, di outgoing High Commissioner of di Islamic Republic of Pakistan to Nigeria as at dat time.

Wia dis foto come from, Twitter/Geoffrey Onyeama
- Same 14, July, Onyeama also received di visit of Ambassador Jamal Mohamed Barrow, Envoy of di Federal Republic of #Somalia. Dem discuss bilateral issues.

Wia dis foto come from, Twitter/Geoffrey Onyeama
- On 13 July, di minister received H.E. Hocine Latli, Ambassador of People's Democratic Republic of Algeria, dem discuss bilateral issues and also do di elbow greeting.

Wia dis foto come from, Twitter/Geoffrey Onyeama
- On 6 July, Onyeama received farewell visit from H.E. Zhou Pingjian, di outgoing Ambassador of di People Republic of China to Nigeria.

Wia dis foto come from, Twittter/Geoffrey Onyeama
- On 4 July, Onyeama post say im receive H.E. Mr Alexey Shebarshin, Ambassador of di Russian Federation to Nigeria di previous day.

Wia dis foto come from, Twitter/Geoffrey Onyeama
Nigeria as at di time of filing dis report get 36,107 total confam cases of di virus. 778 pipo don die while 14,938 pipo don dey discharged.










