Zamfara Governor Bello Mutawalle promise amnesty of 'two cows' for any bandit wey repent and return AK47

Pesin dey hold gun take protect im cows

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Govnor of Zamfara State for northwest Nigeria Bello Mutawalle don call on bandits wey wan repent and live normal life to return one AK47 gun and collect two cows from di goment.

According to statement wey di goment release on Friday, dis method go go a long way to bringing lasting peace to di area wey don witness plenti kill-kill in di last few years.

"Dis no be trade by barter as some media dey report am wey no dey fair but na genuine attempt to help those bandits wey don repent and wan live normal life like every pesin, dis na to empower dem." Di statement tok.

"Some of dis bandits wey wan repent be cow owners before and dem sell di cows to buy dis guns so giving dem some cows in exchange for di weapon na way to encourage dem and make dem beta pipo." Dis na wetin di state goment statement read.

For recent attacks wey happun for di state, gunmen kill ten pipo for Ruwan Tofa town on 20 June dis year. Anoda attack happun for Talata Mafara on 3rd and 4th of June wia 21 pipo die according to Nigeria police.

No be today insecurity start to disturb northwest part of Nigeria wia Zamfara dey. Many pipo don die across oda states wey dey dia like Sokoto, Katsina and Kaduna states.