You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kano marriage proposal video of man wey kneel down propose to im babe don cause problem
Video for social media wey show one young man from Kano state for northern Nigeria kneel down dey put ring for finger of im fiance don cause controversy for di area.
Many pipo wey tok for di streets of Kano and social media dey yan say wetin di young couple do dey against how muslims suppose do marriage proposal or engagement.
Dem say di couple dey copy western style instead of dem to use method wey dia religion and culture agree on.
Kano state islamic police say dem go respond to di video on Wednesday
See some reactions to di video.
How muslims marriage proposal suppose be?
Mallam Dauda Ayuba na Imam for one mosque for Abuja and e tell BBC say wetin di Kano young man do dey wrong and no be Islamic way.
"For Islam if you see a girl wey you like, first thing you go do na to send your elders go meet di girl family. From dia, dem go give you permission to talk.
Den if you and her like each other, na di same elders go siddon again tok say dem don give you di girl for marriage."
End of Di one wey oda users dey read well well
"So nothing like putting ring for fingers or kneeling down dat one no be our style and method." Im tok.