You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Cameroon first daughter Brenda Biya 'America hair wig shop' spark controversy
Kain-by kain reaction dey for social media afta Cameroon President, Paul Biya e pikin, Brenda Biya open shop for Los Angeles-America.
Yesterday, de first pikin open e new shop and de business weh e say na de only tin weh e don succeed for do'am.
From e Instagram post, Brenda Biya say de shop na big shop and salon for woman dem from kain-kain background, and e go sell all kana hand-made human hair wigs.
Na also salon weh top beauty professional fit put de wig dem for woman dia head.
As many pipo di send congratulation messages, odas di ask kweshions laik why e no open de shop for Cameroon.
Some say wit all de business for dis world for sell human hair wig weh e komot for admin school for Cameroon get as e bi.
Odas say wusai e take moni for open business, say na Cameroon tax moni she use for go invest for anoda kontri.
Brenda Biya e papa, President Biya don stay for pawa for 38 years and some kontri pipo di check say dis new business na for prepare e life if e happen say e papa no dey power again.
End of Di one wey oda users dey read well well