Genevieve Nnaji: Di actor don join Oscar Academy afta Netflix hit from Nigerian Nollywood

    • Author, Olaronke Alo
    • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin, Lagos
  • Read am in 3 mins

Nigeria actress don join di list of pipo wey go member of di Oscar Academy.

Di Academy of Motion Picture, Arts and Science extend di invitation to join di organisation to 819 artist and executives wey don don distinguish demsef for di film industry.

Di Nigerian actress enter tweet to respond to di academy to say she accept di invitation

Lionheart wey be Africa first original feem wey Netflix produce land for .

Di feem wey be di first movie Nigeria actress Genevieve Nnaji dey direct, and act, don already dey get accolades for social media on top di release.

How Genevieve rise from Nollywood to Oscar Academy Member

She begin acting at di age of eight, wen she appear for one popular TV soap Ripples.

Her Nollywood career take off wen she play one of di ogbonge roles as female armed robber wey dey disguise as men for di feem, Most Wanted.

Genevieve grow up for di city of Lagos for South West of Nigeria in a middle-class home - her papa na engineer and her mama na teacher.

Maybe her upbringing get hand to shape some of di roles she play for inside movies as many producers don hail am for her roles in movies.

Di 40-year-old don appear for more dan 80 films ova di last two decades.

Yet she suffa one major setback for 2004 wen producers blacklist her along wit oda A-list actors. E no dey clear why dem blacklist her, but reports bin dey say Genevieve dey charge high prices before she accept to play a role in a feem.

Nnaji find herself out of job - so she decide to enta into di music scene. She release one album wey dem call One Logologo Line wey be her one and only album.

Pipo dey remember di album with tracks like No More, a love song: "No more crying oh, No more fighting oh, No more tears oh, I got my freedom, power and more...."

In 2014, di actress try her on fashion wen launch a fashion line wey she call St,Genevieve in partnership wit one of Nigeria big retail stores.

She later go back to movies wen she debut as movie producer in 2015, for di feem, Road to Yesterday.

"Di feem make her realise say life fit dey behind di camera." Screenwriter and director Ishaya Bako wey work wit her on di project tok.

In 2011, Nigeria goment honor her wit award for her contribution to di feem industry.

Wen for 2018 Netflix announce say dem buy di rights to her feem, Lionheart, di first movie she direct. Plenty pipo see dis as massive boost for Nigeria feem industry.

E look like a downturn wen di Oscar Academy reject LionHeart nomination for di category of di Academy's best international feature feem in 2019.

But sake of dat movie, di Nollywood actress get her name on di list of pipo wey dem invite to be members of di Oscar Academy.