You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
PSquare Peter Okoye share how coronavirus infect am, im wife, family for Instagram video and how e affect di Nigerian musician Zoom show
Peter Okoye, im wife and family test positive for coronavirus Covid-19 for three weeks, di Nigerian musician reveal for Instagram video on Saturday.
PSquare zoom show bin dey affected during di period wen im dey self isolation sake of di coronavirus palava, di singer tok.
"Na strong mind I take tok dis tin," na wetin im tok for inside video wey post for im Instagram page.
For weeks I bin dey prison for my house. I bin dey sick. I bin test positive to Covid-19. E take a lot of courage to tok dis say I catch di virus."
Peter Okoye tok say; "I bin tink say di virus tin na joke and I take am for granted."
Okoye say im daughter and wife later test positive, including im cook and one of im nanny too.
Di former PSquare group member say him and im family now dey negative afta dem collect treatment.
"If you think say dis whole virus tin na fake or e neva catch anybody wey you know. I dey tell you know say e dey real," Na wetin Okoye add put.
End of Di one wey oda users dey read well well