You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Rape victim: Uwa, Azeezat, Barakat na victims of violence against women - Dia murders dey make pipo shout say no to rape for Nigeria
- Author, Princess Igho Williams
- Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
- Read am in 3 mins
Incidents of rape and violence against women don dey increase lately as many dey tok say di lockdown don make lot of women dey expose to danger inside Nigeria.
Many of di women wey dis kain tin don affect na young ladies of school age.
Dis na di five women wey don die because of violence against women in recent times across di west African nation:
Grace Oshiagwu
Dem murder Oshiagwu Grace on di 13th of June, 2020 afta report say dem also rape her.
She be di daughter of one CAC pastor for Sasa area of Akinyele Local Government Area inside Oyo State, southwest Nigeria
Di sad incident happun for Mission house behind di church. Grace na 21 years old.
Azeezat Somuyiwa
Dem kill her on di 5th of June, 2020, four days afta di death of Barakat Bello.
She dey seven month pregnant wen dey murder her. Dey smash head with stone.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem murder her for di same Akinyele LGA of Oyo state, same area wia dem kill Barakat.
Police tok say dem don arrest one suspect. She be wenty nine years before dem kill her.
Uwaila Omozuwa
Dem kill Uwa on di 27th of May, 2020 afta her attackers rape her for inside one church Benin City, sourthern Nigeria.
Dem see her corpse inside one of di branches of di Redeemed Christian church of God where she bin go study.
She be 22 years old, and na student of microbiology for di University of Benin wen dem kill her.
According to police, dem don arrest one suspect on top Uwa mata.
Barakat Bello
Dem rape and kill Barak on di 31st of May, 2020.
She be 19 years old and na student of di Institute of Agriculture and research, IART inside Ibadan before her attackers violate and kill her.
Dem rape her around di makeshift bathroom for di back of her parents' house where dey for see her body.
Dey neva arrest any suspect, according to di police for Oyo state, southern Nigeria.
Di oda cases of sexual violence
Jennifer
For April, one a gang of five men attack and rape 18-year-old girl wey dem call Jennifer for Kaduna, northern Nigeria.
Di case come public afta relatives of Jennifer wey dey fear say di men go escape justice, release one video online as family members dey comfort her and pipo share di video plenti plenti times times.
Police later say dem arrest two men for rape and dem dey look for three oda suspects, Aljazera report.
Ada
Many Nigerians still dey call for justice for one 13-year-old girl, Ada wey dem say one 33 years old man rape and give belle for Enugu state, South East Nigeria.
One pesin for Twitter share di story and call on Nigerians to help save di girl and add say she still dey alive.
Oda pipo for twitter reply to di tweet while some odas still continue to tweet wetin dem sabi about di tori of di 13 years old and call for justice.
Police dey investigate all di cases dem wey dey inside dis tori and BBC Pidgin dey followw up on di mata.