Ghanaian-Americans make history as mother den daughter graduate as doctors together

Wia dis foto come from, Other
Two Ghanaian-Americans make history for US as dem be de described first mother-and-daughter duo to attend medical school at de same time, dem post dem to the same hospital, LSU Health for Louisiana.
Cynthia Kudji wey dem born for Ghanaian town, Kenyasi, den en daughter Jasmine both graduate few weeks ago wey dem already dey work on de front line of de Covid-19 pandemic.
Cynthia talk say working with plus daughter check like "dream come true".
She bin put her dream to become doctor on hold wen she bin get belle for Cynthia. She bin work as nurse for nearly ten years before she come decide say she still wan be doctor.
Cynthia Kudji talk BBC say despite "my inspiration dey come from Jasmine. If you get young child you want make dem be better pass you."
Both mother and daughter help each other during dema studies, although dem no dey same place all de time dem study together through Skype and FaceTime.
Jasmine talk BBC Focus on Africa presenter Bola Mosuro say she dey hope say dema experience go prove as inspiration give others.
"I feel so proud say I go through dis journey plus my mum - to inspire other women den other people of colour to do the same thing.
End of Di one wey oda users dey read well well
"I just make so excited to continue on dis journey."
Mother and daughter now dey on de frontline dey help fight coronavirus for US.











