Boko Haram attack: Dem kill 81 pipo come kidnap seven for Borno, northeast Nigeria

    • Author, Moseph Ekine
    • Role, BBC News Pidgin

Number of pipo wey don die from one attack for Borno State, north-east Nigeria don climb to 81 according to authorities.

On Tuesday, unknown fighters arrive inside motor enter one village for Gubio wey no far from di capital Maiduguri come open fire.

Dem also kidnap seven pipo but e no dey clear who carry out di attack, but some residents blame fighters from di Islamic State West Africa Province.

But one eyewitness tell Borno State govnor, Babagana Umara Zulum wen e travel go Faduma Kolomdi village for Gubio local goment area say "na insurgents carry out di attack and dem even steal 400 cattles".

E no dey clear as to wetin cause di attack but di govnor want make di Nigerian military carry out final onslaught wey go put an end to di insurgents.

Im say: "Last year, dem kill about same number of pipo for Gajiram like e happun again. Dis dey barbaric, e dey unfortunate. Di only solution to end dis massacre no to knock off di insurgents for di shores of Lake Chad. To do so go require collaborative regional efforts."

Meanwhile, President Muhammadu Buhari condemn di attack and charge di armed forces to sustain dia recent successes against terrorists and bring back all di pipo wey dem kidnap as well as di large number of cattles wey di jaguda pipo carry.

Jihadists don target di area wia di latest attack take place for some time now. counter terrorism expert say dis recent attack na one of di biggest attacks on civilians dis year.

Times Borno state don come under attack in di last one year

Dis no go be di first time wey Jihadists go attack di Nigerian north-eastern state, as ova di last ten years attacks for di region don dey happun.

Since wen President Buhari enter office for second term wit promise to end di insurgency, attacks by di group for Borno never stop.

  • For May 2020, at least 17 pipo die and anoda 23 wunjure afta gunmen attack Gajigana village for Magumeri local goment area, Borno State.
  • At least 30 passengers bin die wen dem come under attack for Auno village wey no too far from di state capital for February 2020. Sources say insurgent attack and kill passengers wey bin dey stranded. Dem shoot and kill di victims wey include pipo wey dey leave for di area and travellers - odas burn beyond recognition. Dis na di second time wey di town come under attack inside 2020 afta di first one happun for January.
  • Askira-Uba local goment area bin come under attack for December 2019, afta jaguda pipo raid Rumirgo, Lassa, Mussa, Kufa and Chul villages.