Is Olu Jacobs dead or alive: Olu Jacobs, Rema, Pete Edochie, oda Nigerian celebs wey don read fake news of dia death while dem still dey alive

Wia dis foto come from, OluJacobs/Instagram
- Author, Moseph Ekine
- Role, BBC News Pidgin
- Read am in 2 mins
Fake news na one tin wey dey cause katakata and dis time, e carry e kaya come di domot of veteran Nollywood actor Olu Jacobs.
On Tuesday 10 June, rumour begin spread for Nigeria social media say di 77 years actor don die.
But di tori no dey true according to movie producer Lala Akindoju wey say "Uncle Olu Jacobs dey alive and well" afta she tok to am for phone.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis no go be di first time wey fake tori of di death of Nigerian celeb go trend for social media whereas di celeb still dey alive.
Oda Nigerian celebs wey fake news pipo kill

Wia dis foto come from, Lincon Edochie
Pete Edochie
Not once, not twice wey internet pipo don report di death of popular Nigerian actor, Pete Edochie.
For 2012, one tori bin comot say di Things fall apart star die for Austria wen e bin dey shoot one movie. Dem say e fall from 50 feet for di Hahnenkamm mountains.
Even sef for 2016 , Yul Edochie wey be di son of di actor come out to debunk one report wey say im father don die as e say im "father alive and well".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

Wia dis foto come from, Twitter/@heisrema
Rema
Report of di death of fast rising singer Divine Ikubor alias Rema bin comot for February 2020.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di tori bin look real afta di singer Wikipedia page reflect say e don die.
But Rema manager Sean Okeke bin tell BBC Pidgin dat time say "Rema no die o - na pesin hack im wikipedia page put dat fake informate."
Since dat rumour, Rema don even release anoda banger wey e call Beamer, more proof to show say im still dey alive.
SkyB
For October 2019, Nigeria rapper and singer, SkyB die for internet. At least na so pipo begin report but e turn out to be fake tori as di singer tok for Instagram say "im dey alive oh."
Di Pray for me singer say na for movie wey im bin dey act na dia im die, no be for real life.











