Latest coronavirus news: See di Nigerian airports wey don get green light to fly passengers on June 21

Wia dis foto come from, FAAN
- Author, Fiona Equere
- Role, BBC News Pidgin
Nigeria goment don announce say dem go reopen only five airports and flight operations go resume Saturday, June 21.
For inside statement wey di Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA) release, apart from di five selected airports, all odas go remain closed for now.
Dem also say Nigeria airspace dey closed to international flights.
Na since March 23, Nigeria goment suspend flights sake of di outbreak of coronavirus.

Wia dis foto come from, Instagram/flyairpeace
See di Airport wey go begin operate again
- Nnamdi Azikwe International Airport Abuja
- Murtala Muhammed International Airport Lagos,
- Omagwa International Airport Port Harcourt
- Sam Mbakwe Airport Owerri
- Mallam Aminu Kano International Airport Kano.
Tori be say dem go open oda airport gradually afta dia review and assessment.








