Lady Gaga Chromatica album, wetin we know

Wia dis foto come from, Getty Images
Lady Gaga release her latest music album, "Chromatica" on Friday May 29 2020.
Gaga enta Instagram to post video herself dey dance to di song, "911" from her new work.
Di 16-track album feature different dance songs.
Tori be say na April 10, she bin dey plan to release "Chromatica" but Gaga announce for March say she don postpone am sake of di coronavirus pandemic.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Di singer don release some songs before she drop di album including her collabo with Ariana Grande, "Rain on Me."
Di album also get songs wey she release before like "Stupid Love" and "Sine From Above," wey feature Elton John.
Gaga also get one track with di group Blackpink.
Dis na Gaga first album since 2016 wey she release "Joanne."
End of Di one wey oda users dey read well well










