Africa Day: Davido, Burna Boy, Tiwa Savage, Paul Okoye, M.anifest dey use YouTube concert celebrate continent

Burna Boy perform for 2019 Coachella Festival

Wia dis foto come from, Kevin Winter/Getty Images

Wetin we call dis foto, Burna Boy perform for 2019 Coachella Festival
Read am in 1 mins

Di 57th Africa Day celebration go happun wit concert wey go feature di biggest music stars for di continent and beyond.

For concert wey Hollywood actor Idris Elba, music legend Angélique Kidjo and Trevor Noah go host, fans go get opportunity to hear dia favourite stars perform on di evening of Monday, 25 May 2020.

Davido, Tiwa Savage, M.anifest, Burna Boy, Awilo Logomba, Grammy nominee Burna Boy and about 30 oda ogbonge musicians don ready to totori fans for di Africa day "Stronger Together" concert.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Di number of artistes wey go perform don make pipo reason am say dis fit be one of di biggest concert wey di continent don see.

Because of coronavirus, all di artiste and guests go dey dia house from wia dem go tok or perform (di concert no go happun for one venue), so as to raise money to fight Covid-19.

MTV Base wey dey partner wit Google to broadcast di concert confam say even international stars like Kirk Franklin, Winston Duke (of Black Panther feem) and Robbie Lyle (of Arsenal Fan TV) go show face.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

South Africa presido Cyril Ramaphosa don confam say imsef go follow participate.

Every year, kontris dey come togeda to celebrate Africa Day wey also commemorate di day dem found Organisation of African Unity on 25 May 1963.

Di concert go start by 4pm West African Time ontop YouTube, MTV Base, Trace TV and di Facebook page of Africa Union.