Ben Ayade of Cross River say small business owners from mama put to 'Okada' riders no go pay tax again

Wia dis foto come from, Presidency
Authorities don stop low income earners for one southern Nigerians state from paying tax sake of say dem dey earn chikini moni.
"I exempt dem because e better for me as govnor make I instead task my brain than to tax my pipo", Di govnor of Cross River state for south-south Nigeria, Ben Ayade tok.
Which category of pipo no go pay tax again?
- Hotels wey get pass 50 rooms
- Okada drivers
- Taxi drivers
- Small saloon owners
- Airport taxi drivers
- Small catering and eatery point (mama put)
- Farmers
- Pipo wey dey hawk
- And all di small-small business owners wey dey di state.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Govnor Ayede tok am for one inauguration of anti-tax agency wey Emma Isong, a bishop head, di governor tok say e no dey okay wen goment no dey provide di needs of di pipo and dem still dey collect tax from dem.

Wia dis foto come from, Cross River goment
Di governor add am say anybodi wey come meet dem to collect tax, make dem tell am say di govnor don order say make dem no pay tax again.
"How pesin go carry banana for head go sell and some produce pipo go dey there dey tax am for produce?"
"How pesin go carry groundnut go sell and one pesin go put check point to collect moni from di groundnut seller?"

Wia dis foto come from, Cross Rivers State images
Governor Ben Ayade say im no dey wired to dey insensitive to weaker pesin, e tok say im don abolish produce staff make farmers earn dia moni and keep am for themself.
End of Di one wey oda users dey read well well
Who no give dem fertilizer, clear land for dem, or prepare soil for dem, why you go tax dem? He ask.
Di responsibility of di new anti-tax agency wey im set na to put an end to illegal taxes for di state.










