Madagascar coronavirus cure: Meet di man and kontri wey dey try 'save' Africa

Andry Rajoelina

Wia dis foto come from, Andry Rajoelina/Twitter

Wetin we call dis foto, Rajoelina na one-time DJ
Read am in 2 mins

For time wey di World dey look for answer to di global coronavirus pandemic, one kontri leader don dey di forefront of di battle.

Madagascar President Andry Rajoelina don catch di world attention wit im 'herbal drink' wey im say dey cure coronavirus.

Although di World Health Organization (WHO) don warn say di drink need further testing, some African kontris don begin enter queue to order am to test.

On 8 April, president Rajoelina announce to di world di "medicinal plant" wey go see Madagascar" change di course of history" sake of im discovery.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Despite wetin WHO tok, Rajoelina say pipo wey dey criticize im solution to coronavirus dey show di West attitude towards tins wey come from Africa.

Im say "If e be say na European kontri actually discover dis remedy, so much doubt go dey? I no tink so."

President Andry Rajoelina for one ceremony to launch Covid Organics for Antananarivo - 20 April 2020

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, President Rajoelina launch Covid Organics wey im say fit cure coronavirus

Who be Andry Rajoelina?

46-years-old Rajoelina na long time businessman and na one-time Disk Jockey alias DJ.

Im enter politics for 2007 wen im contest to be Mayor of Madagascar capital, Antananarivo.

Rajoelina na di 7th president of di island nation, im don marry and get three children.

BBC Pidgin Covid 19 graphics
BBC Pidgin Coronavirus slice

Wetin you suppose know about Madagascar

  • Madagascar na di fourth largest island for di world after Greenland, New Guinea and Borneo
  • Di kontri get population of ova 26 million pipo according to informate from di World Bank
  • According to di United Nations Office on Drugs and Crime, almost one in 10 Malagasies dey smoke weed
  • Madagascar currency name na Malagasy Ariary and for today market, one Ariary dey equal to $3,827
  • Di French na dem colonize Madagascar, di kontri gain independence on June 26, 1960

How many coronavirus cases Madagascar get?

Madagascar get 192 confam coronavirus cases according to informate from John Hopkins University.

Out of dat number, 105 don recover and nobody don die from di virus.