Coronavirus Tips: Face mask fit protect you from Covid-19?

Wetin we call dis Video, Coronavirus Tips: Face mask fit protect you from Covid-19

BBC Pidgin don launch 'Covid-19 in 60 seconds' wey be daily video on tins to know.

Plenty pipo no need face mask like di one inside dis video except say you sick or dey take care of sick person wey dem dey suspect say get coronavirus.

Coronavirus dey enter bodi through di mouth and nose. And pesin fit carry am give anoda by touching eyes, nose or mouth with our hands. E fit even be pesin wey dey inhale droplets directly for coronavirus carrier wey dey cough or sneeze.

So, face mask fit help reduce di spread from pipo wey get di virus fortimes wey you no fit distance your sef well well.

But e dey necessary if you neva catch di virus or if you dey take care of pesin wey dem suspect say e get di virus?

Today topic: 'Face mask fit stop #Coronavirus?' Dis video go show una wetin to do.

Producers: Olaronke Alo, Dan Ikpoyi, Grace Ekpu, Daniel Semeniworima

BBC Pidgin Covid 19 graphics
BBC Pidgin Coronavirus slice