You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Latest news on coronavirus: Health minister say dem no dey against herbal medicine to treat di symptoms of COVID-19
Nigeria health minister Osagie Ehanire say dem no dey against herbal medicine to treat di symptoms of coronavirus or boost pesin immune system
Oga Ehanire tok dia one on Tuesday as im dey ansa kwesions for House of Representatives, Abuja ontop how di Coronavirus mata dey go.
But di condition wey im give na say dem gatz approve di melecine and make sure say im no go be danger to pesin health.
Meanwhile World Health Organization don give strong warning against pipo wey dey use medicine wey dem no approve to treat coronavirus.
Di health join body tok dis one as Madagascar president dey promote one herbal melecine as treatment for Covid-19 patients.