Ghali Umar Na'Abba never die - Di former Speaker don reply pipo wey carri im death rumour

Read am in 1 mins
Ghali Umar Na'Abba say "I dey alive, I dey trap for London"
Dis na di exact words of oga Na'Abba wey bin serve as Speaker of Nigeria House of Representatives between 1999 and 2003 tok as im dey reply pipo wey carri im death rumour.
Di former Speaker wey come from Kano north west Nigeria wia pipo dey die from some kain 'strange sickness' join coronavirus palava, release video on Friday 1 May to dismiss tori wey dey fly upandan say im don die.
Skip Facebook post
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Im add say na London im dey trap since four weeks ago but im no fit return home sake of di lack of flights.









