You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Coronavirus deaths: Covid-19 cases death toll don pass one million across di world
Di number of pipo wey don die from coronavirus don pass one million, as di World Health Organisation still dey try find vaccine.
America get di highest number of Covid 19 deaths, Brazil na di second, India, Mexico and di UK follow for dat order.
UN Secretary-General António Guterres call am a "very bad" figure and "painful milestone".