Coronavirus in Nigeria: President Buhari don extend Lagos, Abuja, Ogun lockdown by 14 days

buhari

Wia dis foto come from, Presidency

Read am in 1 mins

Nigeria president, Muhammadu Buhari don extend di lockdown wey dey for Lagos, Abuja and Ogun state to anoda 14 days.

Di presido yarn dis one today for di broadcast wey im do give everybody for di kontri.

"...afta I don carefully consider di briefings and Report from di Presidential Task Force and di different options wey dey, e dey very important to extend di current restriction of movement for Lagos and Ogun States as well as di FCT for anoda 14 days effective from 11:59 pm on Monday, 13th of April, 2020. "

Di president ask all im kontri men and women to work with goment for di fight against coronavirus.

Watch President Buhari special broadcast to Nigerians here:

Between late February 2020 wen Nigeria announce di first case of Covid-19 for Lagos and mid April 2020, more than 340 pipo don catch di new coronavirus. And at least 10 pipo don die wit more than 90 discharge from hospital.

Currently, no drugs dey wey fit cha cha prevent COVID-19, and even sef no vaccine. As di virus don waka across di world touch pass one million pipo, scientists dey work at breakneck speed to identify ways to slow or stop di disease.

BBC Pidgin Covid 19 graphics
BBC Pidgin Coronavirus slice