Nigeria coronavirus cases: All states for Nigeria don get confamed cases of di infection

    • Author, Annette Arotiba
    • Role, BBC News Pidgin
  • Read am in 2 mins

Cross River State, South-South Nigeria don become di last state for di kontri to report case of coronavirus.

Di Nigeria Centre for Disease and Control for dia latest update say di state wey dey popular for Calabar carnival say five pipo for di state test positive for di virus.

With Cross River wey don get confamed cases, e mean say di infection don reach all di states for di federation.

Di kontri centre of disease and control also report say coronavirus cases for Nigeria don nearly reach 30,000.

Di kontri get 575 new cases as at 7 July. Dem don discharge a total of 11,828 and 654 pipo don die wit di virus.

As at January 12, 2020, na only China get confam case of coronavirus but by January 13, di virus don become global problem, as kontris like Thailand, Japan, South Korea and America begin record dia first cases of di virus.

Afta den, di disease begin spread to oda part of di world, including Africa.

Over six million confam cases of coronavirus na im dey di world according to di latest data wey comot from Johns Hopkins coronavirus Resource Center.

Nigeria bin record di first case of Covid-19 for February 27, afta one Italian man wey enta di kontri test positive for di virus.

For March 9, di kontri confam di second case, one citizen wey get contact wit di Italian man test positive.

Afta den, di kontri begin record more cases.

CASE SUMMARY FOR NIGERIA AS AT 07 JULY 2020

  • Total Samples Tested - 152, 952
  • Total Confirmed cases -29,286
  • Discharged - 11,828
  • Death - 654

Cross River state na di latest state to record coronavirus case since di outbreak of di disease for di kontri as five pipo test positive for di virus.

Lagos state get di highest number of Covid- 19 patients as di confamed cases don pass 11,000.

Di states wey Covid-19 neva enta

Di 36 states for di federation plus FCT don get record of coronavirus.

We don update dis tori