You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Funke Akindele and her husband JJC Skillz plead "Guilty" to Covid-19 lockdown party
Popular Nigerian actress Funke Akindele and her husband JJC Skillz plead "Guilty" for disobeying lockdown order wen dem appear on Monday morning before one Lagos court.
Now di Nollywood star and her husband wey real name na Rasheed Bello don chop fine and order to self isolate for 14 days, meaning goment go keep dem for separate place for dis period of time as dem fail di law.
Lagos State goment for south west Nigeria charge Akindele to court after video of di birthday party she do for her husband JJC inside dia Lagos mansion for Amen estate appear and trend for social media.
Na on Sunday night na im Lagos goment use police arrest Akindele wey become popular for 'Jennifer's diary' feem, sake of say she party inside lockdown.
Both di JJC aka SKILLZ di Nigerian born London & Lagos based husband of actress Funke, and di actress hersef go pay 100 thousand naira fine (wey pass $250USD) each after dem appearing for di magistrate court.
Di court also sentence dem to 14 days community service wit special condition say dem go both visit 10 important public places within Lagos state to educate di public on punishment of not complying wi di no movement order wey goment put sake of di coronavirus.
Di court also tell dem to submit di names and contact details of everi pesin wey bin show face for di Owanbe wey bin take place on Saturday night for dia Lagos masion inside Amen estate.
Singer Naira Marley, wey also show face for di birthday party of JJC dey for police for police hand and dem say dem go charge go court too.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na di Attorney General of Lagos. Moyosore Onigbanjo and Chief Magistrate Yewande Aje-Afunwa be di prosecutors for dis mata.
Goment say she disobey di March 30, 2020 Presidential order to stay inside house for 14 days and not to dey more than 20 pesin togeda in order to stop di spread of di virus.
Some social media users for di kontri para say Akindele disappoint her fans afta video of her husband birthday party show face for dia timeline.
Tori be say as some part of di kontri including Lagos wia di actress dey live dey on lockdown sake of coronavirus her fans say no be good tin for her to do party, invite pipo for dis period.