Coronavirus cases: Buhari Chief of Staff Abba Kyari, Bauchi Govnor Bala Muhammad don catch Covid-19

Chief of Staff Abba Kyari(left) and Bauchi Govnor Bala Muhammad (right)

Wia dis foto come from, Other

Read am in 2 mins

Abba Kyari, di Chief of Staff to President Muahmmadu Buhari and Govnor Bala Mohammed of Bauchi State for north east Nigeria don test positive for coronavirus.

Nigeria Centre for Disease Control confam di cases on Tuesday evening and e come make di number of Coronavirus cases increase to 44 for di kontri.

Kyari just come back from Germany where im go negotiate deal with Siemens AG while Mohammed get contact wit Atibu Abubakar's son wey don test positive.

According to di tweet from di NCDC, di two new cases na from Abuja—where Kyari dey—and Bauchi—where Mohammed dey.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Muktar Gidado wey be tok tok pesin for Govnor Bala Mohammed tok say afta NCDC do six tests for di Govnor bodi di results show say im test positive

bauchi

Wia dis foto come from, Bauchi

Di senior special assistant to di governor on media say di govnor don go quarantine.

"Dis na to inform di general public say di result of di six test wey di NCDC do for His Excellency, Sen. Bala Abdulkadir Mohammed, his family and aides wey follow am go Lagos don comot. Inside di six test, one sample dey positive for coronavirus.

"Di one wey dey positive na di one for His Excellency Senator Bala Abdulkadir Mohammed, the Executive Governor of Bauchi State.

"At dis point, make you know say di govnor dey self-isolation as im doctors and officials of the Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) don take full charge of im quarantine. His excellency dey ask for prayers form everybody and say everyone wey get contact wit am or anyone wey get same medical condition to go test immediately in order to stop spread of di covid-19 [epidemic]"

Meanwhile di NCDC don advise pipo wey bin attend di Africa Magic Viewers Choice -AMVCs award wey bin happun for Lagos on March 14, to cha cha do self Isolation or call dem.

Di Lagos health authorities say dem dey suspect say pesin wey dem don confam to get di virus bin dey for dat event wey be like di African version of Oscars.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Meanwhile Lagos State don order lockdown of Nigeria commercial capital for two weeks sake of coronavirus.

Wetin we call dis Video, Coronavirus tips: How to self-isolate to prevent di spread of Covid-19