Lagos Explosion: Authorities don confam fire disaster for Abule Ado

Authorities don confam fire disaster for Abule Ado for Lagos State, south west Nigeria.
Di fire explosion happun on Sunday around 9 o'clock for Abule Ado area of Amuwo-Odofin local goment area, according to Lagos State Emergency Management Authority (LASEMA).
"E be like bomb, my daughter run come meet me with fear", according to BBC tori pesin wey dey live for di area and hear di explosion.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
BBC Pidgin find out say na gas leak from one gas company for di area fit don cause di palava.
Authorities neva confam weda pipo die for di explosion.

One school for di area don collapse sake of di fire.
Many pipo dey move dia properties out of di area for fear say plenti oil pipelines dey for di area, according to wetin BBC Pidgin find out.

Emergency responders including fire service, police and red cross don rush go di area to rescue di situation.
End of Di one wey oda users dey read well well
Festac Town, Ado Soba also feel di effect of di explosion for Lagos Mainland.
Festac na dat town Nigeria use host di famous Festac '77 cultural festival. Festac town dey 14km from Lagos International Airport.
We dey follow di tori as e dey happun and we go give una update.














