Balogun market fire: Seven buildings burn for di outbreak
Seven buildings dey burn for Balogun market fire outbreak for Lagos Island, Nigeria.
Tok-tok pesin for di Lagos State Emergency Management Agency Nosa Okunbor wey confam di tori give BBC Pidgin say two buildings don collapse already.
Eyewitnesses say di fire start for 9:30am dis morning for Anambra Plaza market, tori be say di mata cause panic as traders bin dey try save dia goods from inside.
Di Director General of Lasema Oluwafemi Oke-Osanyitolu say dem neva know di cause of dis outbreak but e fit be weather naim cause am.

Wia dis foto come from, Twitter/@Gboyegakosile
Di DG say dem dey try put out di fire as di Lagos state federal fire service and NPA Fire service dey on ground to quench di fire make e no spread again.
Nobody die for di incident.
Oke-Osanyitolu say make everybody dey calm on top di mata.
Balogun market na one of di biggest market for West Africa.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis fire dey come two months afta anoda fire for di same market destroy properties worth millions of Naira.
















