Abule Egba fire outbreak: Wetin we know about NNPC pipelineexplosion wey burn parts of Lagos

Abule egba

Wia dis foto come from, @TRAFFICBUTTER

Wetin we call dis foto, Dis no be di first time wey pipeline fire dey destroy tins for Abule Egba area of Lagos

Five pipo die and twenty wunjure wen one oil pipeline catch fire for Abule Egba/Ekoro Road area for Lagos, Nigeria on Sunday night.

Di fire also burn eleven houses, 17 shops houses, 36 trucks plus motor dem and three keke, according to emergency authorities.

Di Lagos State Emergency Response Agency, LASEMA also say about 150 pipo including small pikin dem don lose dia house to di fire.

Emergency authorities don finally quench di whole fire and na di valve wia vandalised petroleum products dey come from, na im dem stop to cut off supply totally from source for di NNPC Station.

Emergency authorities don finally quench di whole fire.

Wia dis foto come from, LASEMA

Wetin we call dis foto, Emergency authorities don finally quench di whole fire.

Anoda pipeline fire bin happun for Ilepo area of Lagos.

Situational Report from further investigations later reveal say di Ilepo fire na as a result of pipeline vandalism.

However no injuries happun to di fire fighters wey LASEMA combined efforts wit Lagos West Response Unit, Dolphin and that of Command Control Center Tiger Squads, LASEMA Fire Team, as well as di Lagos State and Federal Fire Services, di Lagos Rapid Response Squad RRS and oda relevant safety and security agencies were responders.

Dis no be di first time wey pipeline fire dey destroy tins for Abule Egba area of Lagos

For December 2018, fire wey bin start for early mor-mor burn many tins wey include di dealer 26 cars im park for im shop.

Plenti houses plus shops and motor don burn for di early morning fire wey pipe line vandals cause dat time.

Abule Egba dey for di Agege area of Lagos main land.