Coronavirus: La Liga don dey suspended as dey quarantine Real Madrid squad

Wia dis foto come from, Getty Images
Uefa don call emergency meeting for Tuesday wia dem go discuss di possibility of postponing Euro 2020 by one year.
European football governing body go hold video conference meetings to discuss dia response to di coronavirus outbreak.
Discussions go cover all domestic and European competitions, including Euro 2020.
Euro 2020 suppose take place from 12 June-12 July for venues all ova Europe.
Uefa don invite representatives of dia 55 member associations, plus di boards of di European Club Association, di European leagues and representative of world player union Fifpro.
Meanwhile, dem don postpone di second leg of Manchester City last-16 second leg Champions League tie against Real Madrid, wey dem wan play on Tuesday 17 March.
La Liga don also suspend dia league for at least di next two rounds of matches" sake of say dem quarantine Real Madrid squad because of coronavirus.
In addition, Danish Football Association don cancel all football activities for di kontri for two weeks while di Netherlands' Eredivisie don dey suspended until 31 March.
End of Di one wey oda users dey read well well
For Italy, Serie A dey suspended until 3 April, and di kontri dey on lockdown. Two players - Juventus' Daniele Rugani and Sampdoria's Manolo Gabbiadini - test positive to coronavirus.












