You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Gbas-Gbos make Guinea Bissau President resign afta one full day for office
One of di two men wey dem declare as president of Guinea Bissau resign afta just one full day for office.
Despite say im no dey for December election ballot, parliament appoint Cipriano Cassamá, and di majority of di deputies from di parliament no gree support di election victory of di former opposition leader, Umaro Sissoco Embalol.
Dem swear Oga Embalol in as di head of state for one luxury hotel on Thursday after di electoral commission declare am winner of di December's presidential vote.
Di ruling PAIGC party dey challenge di result for di Supreme Court.
Despite say one president don resign, Guinea-Bissau still get two rival prime ministers.