Coronavirus-Virus: Why Saudi Arabia ban Muslim pilgrims for Umrah

Wia dis foto come from, Getty Images
Saudi Arabia don ban foreign pilgrims from entering di kontri five months before di yearly Umrah pilgrimage.
Dis ban go affect pipo wey wan travel go worship for di holy cities of Mecca and Medina as di Kingdom dey try to tackle di spread of coronavirus.
Saudi Arabia announce di ban afta dem confirm 240 cases of coronavirus around di Middle East, mostly for Iran.
Even though say Saudi Arabia neva get any confirmed case of di virus, Saudi goment say di ban na "temporary" one.
For dia statement, di goment say dem go "suspend entry to di Kingdom for di purpose of Umrah and to visit di Prophet Mosque temporarily."
Umrah na Islamic pilgrimage wey muslim fit perform for any time of di year.
Millions of Muslims dey make di journey each year to go pray for Mecca, especially during di month of Ramadan, wey go start for April.
Saudi Arabia also suspend di visa for tourists from kontris wey get confirmed cases of di virus.
End of Di one wey oda users dey read well well
How dis ban go affect Muslims
Sheik Abdullahi Ishaq Garangamawa wey be chief imam for Jafar Adam mosque for Kano northwest Nigeria tell BBC say Saudi Arabia no fit stop annual Hajj and Umrah because na God and Prophet Muhammad (SAW) law.
Di imam wey say e neva miss Hajj and Umrah for 20 years add say wetin Saudi suppose do na to stop pipo from kontris wey get confam cases of Corona virus but not to stop everybody, e no dey possible.
"Hajj and Umrah (lesser Hajj) na God's law and our prophet Muhammad law so Saudi no fit stop am, my belief be say dem go just use the next few weeks or months to prepare wella in case of anytin."












