You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Justice for Chima: 'We don get ova 5,500 petition to demand justice for Chima and Ikoku four'
Rivers Civil Society Organization don set up online petition to gada support for #JusticeForChima and #JusticeForIkokuFive wey police men with E-Crack unit arrest and torture.
Dis petition na also to draw Federal goment attention plus international community to stop all forms of police brutality, so dat wetin happun to Chima and di four Ikoku traders no go happen to anoda pesin.
All dis waka dey happun afta Rivers State goment put ban on protests afta Ikoku traders do 'we no go gree' waka make dem release di corpse of Chima Ikwunado and di Ikoku traders wey dey for detention dat time.
Police for Port Harcourt, Rivers state bin arrest Chima Ikwunado wey be mechanic ontop accuse of armed robbery, na for custody wia im dey im die.
Afta Chima die, Police say autopsy wey dem do show say im die from high sugar level but di family don deny am and request for anoda autopsy to know wetin truly kill am.
Meanwhile, Cousin of Chima, Obinna Ezirim tell BBC Pidgin say dem don see im dead bodi for di first time inside University of Port Harcourt Teaching Hospital mortuary.
Obinna Ezirim say di condition dem see Chima deadibody show say di Police really torture am well well.
"Di condition of di bodi of Chima dey brutal, dem butcher am well-well. Even if dem bin rush Chima go hospital, e for no fit survive am because dem butcher am all ova im bodi." Ezirim tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
"We still dey go ahead with di autopsy report and wetin we want na justice. E no get any amount of money wey goment want give us (Family) to bring back Chima life."
Lawyer to Chima family wey also be legal adviser to Ohaneze Ndigbo for Rivers State, Ozumba Okechukwu say now wey dem don identify Chima deadibody, di autopsy go still go on and dem go seek justice for law court.
Then, di chairman for Rivers Civil Society Organisation, Enefaa Georgewill wey set up di online petition say dem wan use dis Chima case as point of contact to odas so dat police no go torture or maltreat any pesin wey dey dia custody and also make sure say police follow di right process.
Oga Georgewill say already dem don get pass 5,500 signatures for di petition and dem still dey continue with am as more and more pipo dey show interest to put dia signature and add dia own voice to stop police brutality.