Election Results: Main tins we learn from Cameroon parliamentary, municipal vote

- Author, Leocadia Bongben
- Role, BBC News Pidgin, Cameroon
Cameroon vote for dia lawmakers on Sunday even as fighting di go on for Anglophone regions for three years now.
Information from Elections Cameroon (EleCam), di kontri independent office wey dey in charge of organizing elections inside Cameroon, show say thirty three (33) political parties na im present candidates for parliamentary elections while forty-four (43) political parties na im present candidates for municipal elections.
See di main tins we learn from Cameroon 2020 twin elections:
How pipo feel about de elections
Kontri pipo di feel say de election no make any sense especially for place laik, Douala for littoral region weh na Maurice Kamto e stronghold.
So deh no vote, also big community for Anglophones weh deh run for Northwest and Southwest for dis town.
For Anglophone regions deh di fear for komot vote as deh di fear for dia lives.

Wia dis foto come from, Getty Images
Boycott by main opposition
Cameroon Renaissance Movement, CRM for Prof. Maurice Kamto, second big party afta di ruling CPDM for 2018 presidential elections, boycott de elections fro seka de crisis for Anglophone regions.
Deh say make oda parties boycott de elections. Kamto e tok-tok pesin write for Facebook, 'We no go vote, we don boycott'.
End of Di one wey oda users dey read well well
Even political group weh e di fight for change for Cameroon, 'Stand-up for Cameroon' weh Edith Kah Walla na coordinator march for pressure goment for shift de elections.
Lockdown for Anglophone regions (No movement for English speaking regions)
Elections di hold wit Lockdown for Anglophone regions, plenti pipo no go komot for house.
Separatist impose lockdown from number 7 day go reach number 12 day for February for spoil election.
Some churches for de two regions celebrate Sunday mass for Saturday as pipo go remain for dia house for avoid trouble.
Separatists swear say elections no go hold for dia area. Before election violence increase, army and separatists fighters burn houses, kidnap, kill pipo for de two regions.

Wia dis foto come from, Twitter/@PR_Paul_BIYA
Goment send 700 hundred para-military officers for de Anglophone regions on election day
Goment shing for shift dis election even wit all de wuruwuru for Anglophone regions.
Instead goment send 700 hundred para-military officers for de Anglophone regions.
E good for note say deh no bi send dis plenti soldiers for de two regions for presidential elections.
International goments too put dia mouth for inside say make president Biya shift de elections.
First time political parties
Na 33 parties dey for council and 42 for parliamentary elctions
De main parties for dis elections na Cameroon's Peoples Democratic Movement, RDPC, Social Democratic Front, UNIVERS, PURS and National Reconciliation Party, NRP MANIDEM, UPC, UDC.
De first taim for PURS, UNIVERS and NRP parties.

How campaigns bi pass
Campaign for dis election for Anglophone regions bin get special touch as goment ministers enta armoured cars for go campaign for dia villages.
But, opposition no show sign say deh deh for de two regions especially for de villages.
Some political parties mash-mash wrapper for oda parties, tear dia flyers and oda campaign material.
Election Observers
According to Cameroon goment, di Minister of Territorial Administration give access to 16,765 national and foreign observers wey travel to ten (10) Regions.
Concerning di English speaking regions wey be North-West and South-West Regions, di goment tok for statement wey dem release on election night say di population turn out plenty to vote.
Di goment also claim say na ova 150 journalists na im dem give access to cover elections inside dis two regions.

Wia dis foto come from, Getty Images
Voting taim, voters, seats, term of office
For dis February 9 twin elections, from 8:00am go reach 6:00pm over 6 million Cameroonians go vote for 180 parliamentarians, and 360 councillors.
Deh lawmakers and councillors go make for office for 5 years.















