Maryam Sanda: Court rule say woman wey stab her husband to death go die by hanging

Abuja High Court don sentence Maryam Sanda to death by hanging afta dem find her guilty for di murder of her husband, Bilyaminu Bello.

Justice Halilu Yusuf of di FCT High Court tok say all di evidence wey dem present point to di fact say she dey guilty of homicide.

Justice Yusuf say 'blood for blood' and dat anybody wey kill anoda human being, im sef deserve to die.

E explain say di way wey husband and wife dey kill each oda for di kontri don too much and dis case suppose serve as warning to many for di society.

E say make dem cari Maryam go Suleja Correctional centre pending wen she go finish all her appeal.

Dem bin arrest Maryam for November 2017 say she stab her husband, Bilyaminu Bello to death.

Bilyaminu na di pikin of one former chairman of Nigeria main opposition party, di People's Democratic Party (PDP), Haliru Bello.

How e happun

Maryam Sanda bin marry Bilyaminu Bello, di son of di former PDP Chairman, Haliru Bello but for 2017, gbege come start afta she claim say she find naked woman picture for her husband phone.She come tell her husband make he divorce her if not she go cut im penis.

Di Nigerian Police bin charge her go Court for accuse of culpable homicide for November 2017 and dem bin demand for death penalty on top two-count charge.

Di police prosecution lawyers, Ogbobe Fidelis bin don argue tell court say she bin plan di attack sake of say she chuk her husband broken bottle for around 3:50 wit di mind to kill am.But madam Maryam cry give court say she no kill her husband and dat di husband die afta e fall on top shisha bottle for di house afta dem dey quarrel.

Di lawyer to Maryam, Regina Okotie -Eboh bin argue say, police no fit show any murder weapon, wey Maryam use to commit di murder.

But di court say from all di evidence wey dey before am, di court no even need medical report to prove say Maryam true-true kill di husband.

Di judge say as e be, na Maryam be di last person wey dey wit di husband and as per doctrine of di last person, na only her get to prove wetin cause her husband death and from her evidence, she never prove beyond doubt say she no kill her husband.

Na for three years na im dis mata drag and as di judge dey give di summary of di case, e say di testimony wey all di witnesses give for di mata show say madam Maryam no dey innocent as she dey claim, as di witnesses say she bin dey threaten her husband, plus cari knife say she go cut im penis.

As di court pass di judgement, na so Maryam begin cry say make dem kill am dia-dia as she no know wetin do her husband.