Queen don agree for Harry and Meghan to get 'transition period'

Di Queen, di Duchess of Sussex and di Duke of Sussex

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Queen don agree for "period of transition" wia di Duke and Duchess of Sussex go spend time for Canada and di UK.

She tok for statement say she dey "entirely supportive" of dia desire for new role but "for prefe for dem to remain full-time working members of di Royal Family".

She say more work dey to do ontop di "complex matters" but she expect ay dem go reach final decisions in di coming days.

Senior royals don dey do tok-tok about Prince Harry and Meghan role afta dem say dem wan "step back".

Inside statement, di Queen say di the toks for Sandringham, wey also involve di Prince of Wales and di Duke of Cambridge, go very well.

"My family and I dey entirely supportive of Harry and Meghan desire to create new life as a young family," she tok.

"Although we for prefer make dem remain full-time working members of di Royal Family, we respect and understand dia wish to live a more independent life as a family while dem also remain important part of my family."

She say dem don agree say dey go be "period of transition wia di Sussexes go spend time for Canada and di UK" afta Harry and Meghan "made am clear say dem no want to dey rely on public funds for dia new lives".

"These na complex matters for my family to resolve, and some more work dey to do, but I don ask for final decisions to ready in di coming days," she tok.