You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kaduna gas explosion: Five pipo die, four injure for Sabon Tasha
Gas explosion don kill five pipo and injure four odas for Kaduna North central Nigeria.
Pipo wey take eye see am say di explosion happun for Saturday afternoon, for one gas shop for Sabon Tasha area.
Na tok-tok pesin of police for di state Yakubu Sambo confam di tori give BBC Pidgin, and di Kaduna Police command release statement say di incident burn two of di pipo to wia dem no fit recognize dem.
Di statement also tok sat di fire affect three shops wey dey di area. Also, say dem don cari di pipo wey injure go di Barau Dikko Hospital for di state.
Meanwhile di state goment don send condolence message give families wey lose dia loved ones for di explosion.
Di Commissioner for Internal Security Samuel Aruwan tweet say di happun along Kachia road, Sabon Tasha for Chukun local goment area.
Senator Uba Sani wey dey represent Kaduna Central also send message to tok sorry.
We don update dis tori.
End of Di one wey oda users dey read well well