Abuja bank robbery: Police arrest di 'brain' behind di attack

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria police for di kontri capital Abuja say dem don arrest di brain behind di failed arm robbery attack wey happun for Mpape, last Saturday.
According to di police, di suspect Ernest Ewim na barman, wey dem arrest for wia im bin dey hide for Katampe, Abuja. E dey police head quarters for Garki, Abuja.
Di arrest of di suspect dey come less dan one week afta di failed arm robbery attack.
Some days ago, dem parade di gang of suspected thiefs, Larry Ehizo, 30 years, wey be staff of di bank, Timothy Joe, 21, Princewill Obinna, 24, and Elijah David, 19.
Ehizo wey bin drive di thief dem for im 206 go di bank, claim say Ernest di bar man bin blackmail am to go thief for di bank.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di sixth suspect bin die inside di shoot out on di day of di incident.
According to one of di thief David, Ehizo tell dem say Saturday na di best time to go steal N7million as na only few of di workers go come work dat day.
End of Di one wey oda users dey read well well











