You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Abuja bank robbery: How police kill suspect, spoil bank robbers show for Mpape
Read am in 1 mins
Police for Nigeria capital city, Abuja pour sand sand for planned robbery attempt by bank robbers on Saturday.
Tori be say di police shoot kill one suspect and arrest four odas inside di First Bank Plc branch for Mpape.
Di robbers bin trap inside di banking hall for some hours afta police arrive and come surround di building.
Local tori pipo Channels dey report say dem arrest four of di robbers and di situation now don dey under control.
Some videos wey dey for Twitter show as police try to access di building from di roof and also one show how dem arrest one suspect.