Imported for my body: Di African women wey dem dey send go India for sex
BBC Africa Eye uncover one illegal network wey dey carry women go India from Africa, wia dem go den force dem to do ashawo work to satisfy di demands of di many African men wey dey live for Delhi.
Di women na mostly from Kenya, Uganda, Nigeria, Tanzania and Rwanda.
One woman, Grace wey dem carry go Kenya for ashawo work agree to go undercover for BBC.

