Na hia we go march break
We go leave una wit di full video.
All di latest tori as e dey hot ontop di BBC 'Sex for Grades' video wey expose sexual harassment by lecturers for West Africa big-big universities.
Daniel Semeniworima and Fiona Equere
We go leave una wit di full video.
Former vice president and di presidential candidate of People’s Democratic Party PDP Atiku Abubakar don release press statement for di Sex for Grades mata.
For statement wey im tok tok persin , Paul Ibe sign, Atiku believe say we no suppose dey allow make dem dey abuse young women psychologically. No be wetin education system suppose represent be dat.
Im say make dem sama correct punishment give di lecturers wey dey do dis kain thing and make plan dey to help di students wey wey be victims like di person wey wan kill imsef three times afta lecturer abuse am.
Atiku say for di school wey im found, American University Nigeria no dey tolerate sexual harassment.
“Di school get code of conduct wey dey deal with sexual harassment mata and how student go report am.” Im tok.
Di former presido don say belle sweet am say bbc Africa eye dey do documentary wey dey torch light mata wey dey help change things for Nigeria.
�֊6*�B
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Former education minister Oby Ezekwesili, don react to Foursquare Gospel Church decision wey ask dia pastor Boniface Igbeneghu to step down afta im appear for BBC sexual harassment video.
Madam Oby say dia action go help fight dis mata.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Management of University of Lagos don order make dem shut down di staff club “Cold Room” wey dem mention for BBC Africa documentary wey expose lecturers wey dey ask female students for grades
“Di so-called “Cold Room”na function room wey lecturers don abuse because no be wetin we create am for be dat. We create am for meetings, Seminars, events etc.” Di University tok for press release
Di University tok give member of public say di oda lecturer wey dey di full documentary go still face suspension and dem go torch light di mata.
Di University assure members of di public say any oda lecturer wey im name dey mentioned inside di full version of di video wey BBC go release later today, go also chop suspension to ensure a proper investigation happun.
Pipo from Nigerian and Ghana dey respond
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5

End of X post, 6

University of Lagos says dem don suspend one of dia lecturer wey appear for BBC documentary ontop sexual harassment.
Dis dey come afta Dr Boniface Igbeneghu, wey also be pastor chop suspension from im church.
Plenty pipo para ontop social media afta video show as di lecturer dey sexually harass one undercover reporter, wey pose as prospective student.
According to di office of di Vice Chancellor Prof. Oluwatoyin Ogundipe, di school management don watch di video and find am embarrassing to di university.
Dr. Boniface name begin trend for social media afta di BBC Africa Eye/BBC Pidgin video show am dey tok about cold room experience for University of Lagos.
Dr Boniface suspension from academic work for di federal goment university na till further notice.
Di BBC video expose sexual harassment by lecturers for West Africa big-big universities.

Ghana lecturer wey show for BBC Africa Eye/BBC Pidgin Sex for Grades video cry for Twitter video
Di video wey @awww_ghostTears post for Twitter wey BBC Pidgin no fit verify show one of di lecturer wey appear for di #SexForGrades video dey cry.
For video Prof Ransford Gyampo dey cry in front of students for class wey dey boo am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Former Nigeria Senate President Bukola Saraki tweet say im dey shock by di action of lecturers wey appear for di #SexForGrades video.
Sararki say "we no fit allow dis kind bad behaviour to continue".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Bukola Saraki Facebook
Ogbonge Nollywood actress Uche Jumbo Rodriguez tweet say: "We get proper problem wit sex abuse culture for Africa…"

Wia dis foto come from, Uche Jumbo Rodriguez Instagram
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
One civil society organization wey sabi carri public mata for head don tell University of Lagos to investigate di senior lecturer wey dey face accuse of SexForGrades.
Socio Economic Right for Accountability Project (Serap) for Nigeria give di school seven days to take action or dem go carri dem go court.
Boniface Igbeneghu wey also be pastor of Foursquare Gospel Church for Lagos, appear for BBC documentary video wey investigate how students dey face sexual harassment by lecturers for some West Africa universities.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di hashtag #SexForGrades dey trend for Twitter for Nigeria.
See some of di memes wey pipo dey use tok about di mata for Social Media.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4

Foursquare Gospel Church don ask one of dia pastor wey be lecturer wey im face show for di sex for grades video to step down from all ministerial assignments.
For inside statement wey di church post for Twitter dem say dem go take action as soon as dem complete dia investigation of Boniface Igbeneghu.