NNPC: Pipeline fire explosion claim lives for Lagos

Read am in 1 mins

Pipeline wey explode on Thursday morning kill at least two pipo near Glory and Diamond Estates for Isheri local goment, Lagos, Nigeria commercial capital.

Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA), say di oil pipeline wey dey inside Diamond Estate break come dey leak petrol and na im cause di fire wey dey burn for four different points.

Di agency conam say two pipo burn die inside di fire and dem don cari dem bodi go mortuary.

NNPC - Nigeria National Petroleum Corporation wey be di kontri national oil company confam say di explosion but tok say di fire no go affect dia production and petrol supply across Nigeria.

Di rescue team also cari man wey burn reach 70% go General Hospital.

Di emergency agency say fire service don quench di fire.