Ikoyi prison: Electric shock don kill five inmates, injure seven

Five inmates don die and seven wunjure inside 'Ikoyi Prison' for Lagos Nigeria, afta electricity shock dem on Monday.
Controller General of di Nigeria Correctional Service, Ahmed Ja'afaru confam di tori.
Oga Ahmed say di incident happen around 7am but im refuse to explain wetin really cause di 'electrocution'
Di Minister of Interior Rauf Aragbesola wey come di site of di incident tell tori pipo tok say di goment go open investigation into di mata, and di pipo wey dey behind di incident go face di law.
According to Ahmed, di Nigerian goment no dey torchlight prison welfare matter like dem suppose.
"Dis na place wey dem originally do for 800 inmates but today e get about 3,113 inside," Ahmed bin tell tori pipo.
Out of di 3,113 inmates wey dey Ikoyi Medium Security Custodial Center, 2,680 dey await trial.
For press statement wey di Controller General release, dem say dis particular cell wia di disaster happen for get capacity for 35 but na 140 inmates dem jam pack inside.
End of Di one wey oda users dey read well well
Over population na mata wey don dey affect Nigerian prisons for a very long time now.












