You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ghana debt stock hit 208.6 billion cedis – Bank of Ghana
Bank of Ghana data wey dem release dey show say as of ending of September, de debt stock hit Ghc208.6 billion.
Data released by the Bank of Ghana shows that between July and September 2019, Ghana's total debt stock increased by 3.1 billion cedis, hitting 208.6 billion cedis.
From de figures wey BoG release inside dema Summary of Economic and Financial Data de total debt stock of 208.6 billion cedis dey represent 60.3 percent of Gross Domestic Product (GDP).
Around November last year, de total debt stock for Ghana dey stand at Ghc170 billion, which be like 57.2 percent of GDP.
Why Ghana debt dey increase
De increase in debt stock over in de last two years according to analysts be sake of how de Ghana cedi dey lose value for de market top plus de recent monies wey govment dey spend to clean up de banking sector.
Based on de debt wey Ghana dey owe, if dem divide Ghc208.6 billion by de population of about 30million people, e dey mean say each Ghanaian dey owe Ghc6,950.
Some analysts believe say Ghanaians go pay for dis debt in de form of taxes.