You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Allen Onyema: Wetin you need to know about Air Peace Oga
Allen Onyema na di oga kpatapata of Nigeria Airlines Air peace wey start for 2013.
For September, Oga Onyema, use im airline take carri 188 pipo return to Nigeria afta di xenophobic attack for South Africa.
Im action for di xenophobic attack make many Nigerians to hail am for social media.
Wetin you need to know about di Air Peace Oga
Allen Onyema from Mbosi town for Ihiala Local Government Area of Anambra State, South East region of Nigeria.
Im study Law for University of Ibadan and attend Nigerian Law School between 1987/88 before dem call to bar for 1989.
Oga Onyema get four children one girl and three boys
Di Air Peace oga name im aeroplane afta pipo for im family. Di executive jet get Michael, dat na im papa name. One Domier 328 jet name na Helen im mama name. Di oda Domier 328 name na Ojochide wey be im wife name.
Di first four B737 get di names of im four children; Nnenna- im first pikin and daughter, Chinonso- im first son, Obinna - im second son and Ugochukwu - im last son.
End of Di one wey oda users dey read well well
Because of im contribution for di xenophobic attacks against Nigerians, many social media users for Nigeria choose am as man of di year.