Okobaba plank market Ebute Metta: How fire burn di biggest wood market for West Africa

Fire burn destroy properties for di biggest wood market inside West Africa on Friday afternoon.
Plenti shanties na im di fire don burn for Okobaba Plank Market wey dey for Kano Street Ebute Metta Lagos State, South West Nigeria, according to emergency service.
"Na high voltage light cause di fire wey start around 1PM", one eyewitness tell BBC News Pidgin.
But di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) tok say dem neva still know wetin cause di fire.

Wia dis foto come from, Ayodele
LASEMA tok say di fire dey burn well-well so tey e don spread to go oda buildings wey dey around dia.
Di tok-tok pesin for LASEMA, Nosa Okunbor say no body die or injury but properties wey worth plenti money na im di fire don destroy.
E add say di Lagos Rapid Respond (LRT), Lagos state fire service, Police and odas don rush go wia di fire dey burn and dem dey worki togeda to reduce di spread of di fire.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
"I dey for my work place wen dem tell me say di place dey burn and my two children dey inside house, till now I neva see dem"
End of Di one wey oda users dey read well well
Dat na wetin Toyin wey be victim of di fire incident tell BBC Pidgin tori pesin Andrew Gift wey go di area.
Wit wetin we tori pesin see for ground, plenti pipo no go see wia to sleep dis night as dia house burn to dust Plenti of dem no pick anytine from dia house and shop wey burn.
Fire fighters tell BBC say area boys no gree dem enta inside to quench di fire. Area boys wey carri cutlass and local weapons block our reporter and oda reporters wey come to cover di incident.

Wia dis foto come from, Ayodele
Di area don cath fire before.
See some of di foto of di fire



We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.












