Onitsha market fire: Fuel tanker explosion don cause palava

Wia dis foto come from, @Followlastma
Katakata burst for Onitsha, Anambra south east Nigeria afta tanker wey cari fuel fall, catch serious fire wey later spread long distance.
Di fire wey area pipo say burn well-well start since twelve for afternoon reach evening.
- LATEST UPDATE: "We dey on awa own" - How Onitsha market fire break hearts
One pesin wey dey stay di area tell BBC say di fire affect Ochanja and Relief markets.
Although police say di fire don reduce compare to wen e first start, dem neva sabi weda pipo die inside di fire.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Inside videos and foto wey pipo share for social media, some pipo bin dey run helter skelter for dia life and property while odas dey hustle to try get water quench di fire.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3
Meanwhile, di Anambra state govnor Willie Obiano, don set up panel to chook eye for di mata.
Di govnor don also invite all di pipo wey di fire affect to gada on Monday October 21 to see how goment go fit to helep dem.