Sex for Grades: Senate reintroduce bill to jail 'sex for grades' Nigerian lecturers

Nigeria senate on Wednesday reintroduce di sexual harassment prohibition bill wey dey seek to prevent sexual harassment of students for universities.
Dis dey come afta 48 hours afta BBC investigative documentary expose plenti sexual misconduct by lecturers for two top Universities for West Africa (University of Lagos, Nigeria and University of Ghana).
Deputy president of Nigeria Senate Ovie Omo-Agege na im dey sponsor di bill as im say e hope di BBC investigate go help ginger support for di bill.
Di bill want five to fourteen year prison term for any teaching staff wey get sexual relationship wit dia student.
Dis no be di first time dis bill go enta senate as for 2016 di senate pass di bill but come later fail to get di support of di house of representatives as dem feel say e no cover oda areas of society.
Senator Omo-Agege add say as pesin papa wey im be, sexual harassment for universities na issue wey im no fit accept. Di senate come later read di bill.
If dem pass di bill, e go also dey illegal for lecturers to make sexual moves towards dia students.
Former senate president, Bukola Saraki on Monday bin ask di national assembly to revisit di bill so change go dey for tertiary institutions.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Many pipo don come out tok dia mind afta di broadcast of di BBC documentary wey contain hidden video of lecturers for di University of Ghana and di University of Lagos as dem dey sexually harass undercover reporters wey fake say dem be students for universities.
Both institutions don comeout tok say dia hand no dey for di claims and suspend di lecturers wey dey involved. Di lecturers too don deny di allegations.













