You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
BBNaija: Diane time for di 2019 reality TV show don end
Big Brother don evict Diane Yashim from di reality TV show.
Diane eviction come as surprise to di housemates as dem been no expect any oda eviction since dem don enta di last week of di show.
Big Brother tell Frodd to use im veto power once again as im come reveal say Diane and Omashola na dem be di two housemate wey dey up for eviction as nobody been nominate dem last week.
Biggie come ask Omashola and Diane to write dia names on di gold coins wey dem get come put am inside black bag for Frodd to pick at random.
Im tell Frodd say di first coin im go pick out wey get di name of either of di housemates na im go automatically chop eviction. Na so Frodd come pick Diane.
As e be so Mike, Mercy, Seyi, Frodd and Omashola na dem be di five finalists for di 2019 edition of Big Brother Naija 'pepperdem' season.