Kidnappers don free Samson Siasia mama

Madam Ogere Beauty Siasia, Samson Siasia mama

Wia dis foto come from, Amabebelakumo James Siasia

Wetin we call dis foto, Few days ago, Siasia bin beg di kidnappers make dem free im mama

Di mama of former Nigeria Super Eagles coach Samson Siasia don regain her freedom afta she spend ova two months for kidnappers hand.

Ewerikumo Siasia, wey be family member confirm to BBC Pidgin say dem free madam Ogoere Beauty Siasia on Saturday night.

Im say di kidnappers also release two oda women wey dem kidnap alongside mama Beauty.

Former Nigeria coach Samson Siasia

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Samson Siasia coach Nigeria when dem win bronze for di 2016 Olympics for Rio.

For midnight of 15 July, gunmen enta di house of Beauty Siasia and kidnap her inside di riverine village of Odoni, Sagbama Local Government Area, Bayelsa State, Southern Nigeria.

Police tok tok pesin for Bayelsa, Butswat Asimin, wey also confirm di release to BBC pidgin say, dem dey "go di community to see di victims and ask dem question about wetin happun".