You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Port Harcourt hotel Killing: Police parade fourth suspect
Nigeria police don parade di fourth suspect wey dem say get hand ontop di killing of women for Port Harcourt, Rivers state Nigeria.
Police parade the thirty-nine years old two days afta dem confam say dem don arrest three suspects ontop di mata.
Rivers State Commissioner for Police, Mustapha Dandaura during di parade blame di insecurity of di state on top plenty political divides and say police go ensure to catch oda pipo wey dey involve for di killing.
Di police oga add say di suspect don make useful statements to epp dem for di case.Police for Port Harcourt, Rivers state Nigeria parade di fourth suspect, one Mr Gracious David West wey dem say get hand for di serial killings for di state.
Di police oga add say di suspect don make useful statements to epp dem for di case.