Jarrid Wilson, pastor and mental health advocate don kill imself

Jarrid Wilson

Wia dis foto come from, Facebook

Read am in 2 mins

One church pastor for America wey dey promote and encourage pipo about mental health don kill imsef.

Jarrid Wilson wey be 30 years old, dey work for di 15,000 member Harvest Christian Fellowship Church for 18 months before im die.

Pastor Wilson and im wife, Juli na im found Anthem of Hope, one programme wey dem create to help pipo wey dey deal with depression.

Juli wey born two sons for Wilson write say di news about her husband death don "completely break her heart".

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Presentational white space

Senior Pastor Greg Laurie, wey dey lead di church for southern California, na im confam di death of oga Wilson.

E write for di church website say "Jarrid love di Lord and im get servant heart. E dey active, positive, and dey always serve and help odas".

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Pastor Laurie add say Jarrid don dey deal with depression since and im dey very open about im struggle. E say Jarrid want to especially help those wey dey deal with suicidal thoughts.

Anoda pastor for di church, Jason Powell, also pay tribute.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Presentational white space

Just before e kill imsef, Wilson tweet about officiating di funeral of one"Jesus-loving woman wey take her own life".

"Loving Jesus no dey always cure suicidal thoughts. Loving Jesus no dey always cure depression," e write.

Jarrid with his wife and two children

Wia dis foto come from, Instagram

"But dat no mean say Jesus no dey offer us companionship and comfort," e continue. "He ALWAYS dey give us dat."

One fundraiser to support Wilson family don raise more than $42,000 (£34,000) as at on Wednesday.